Senator Dino Melaye don make am dey clear as him talk say, him dey ready to fight any move by di Federal government and Buhari to silence him or shut down him criticisms.
Melaye,wey be senator wey dey represent Kogi-west for Senate, don react via social media to two count charge FG file against am against based on wetin dem talk say him give false information to di police for di matter wey concern di claims him make on April 17 on top di attempt on him life. He write on him Twitter Say,
“Di same police who parade di assassination, dia weapons, dia cars wey dem use , get di confessional statements of suspects, dey ask me who be my suspects now and dey do meeting with Minister of Justice to arrest me for misinformation on top case wey dey for Court where di court don already accepte Di statements of suspects as exhibits.
“Me wey be victim of assassination attempt dey now to face trial. I go fight you all with di last drop of blood wey dey my body. I no fit be cowed or fit dey silent on top perfidy, Corruption, injustice and Mal- administration, even or presidency no fit.
“For dis unjust society ,silence is be crime. I no fit stop speaking di truth to power wey dey all levels. You go dey continue to hear from me everytimes. If I die For di process ,make e be . I ready for una.”